Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Federal Government don start lab check to sabi wetin dey cause the strange flesh-eating disease wey don kill seven people for Malabu, Adamawa State.Dr. Adesigbin Olufemi, wey be Acting National Coordinator for National Tuberculosis, Buruli Ulcer and Leprosy Control Programme, yarn dis one for interview wey happen for Abuja. Olufemi talk say as at September 10, dem don confirm 67 people wey get di disease, and eight of dem dey collect surgical treatment for Modibbo Adama University Teaching Hospital (MAUTH) for Yola. “Na government dey support di surgical treatment wey these ones dey go through,” Olufemi talk, as e still stress say na joint effort dem dey use handle di medical gbege for the communities wey di disease don show face.Di disease dey start like small boil, e go later burst, then e go begin chop flesh small small sometimes e even reach bone come scatter am for the area wey e catch. Olufemi talk say even though dem never sabi the exact cause, dem dey suspect say na Buruli Ulcer. Dis tropical disease still dey under investigation to confirm am,” he yan. He come explain say na Mycobacterium ulcerans, one kain bacteria wey dey waka for swampy areas and places wey river water no dey flow, dey cause Buruli Ulcer.Up till now, nobody sure how di disease dey take spread. Some people believe say na insects like water fleas or mosquitoes fit pass di bacteria give person when dem bite,” Olufemi add.
Di coordinator hail di sharp response of Adamawa State Government, plus support from federal agencies and one NGO partner wey dem call REDAID, wey land for ground on September 14. He talk say people wey get small-small symptoms dey receive treatment for local health centres, but those wey di matter don serious and need surgery, dem don carry go better hospitals wey sabi handle that kain case. Olufemi point out say public awareness na very important, especially as some people for di area first believe say na witchcraft dey cause di disease, and that one make dem delay go hospital for proper treatment. One of di main things wey really matter, and na wetin we dey do now na to continue dey create awareness,” he talk, as he beg residents make dem no waste time, but go find medical help quick once dem notice symptoms. Olufemi stress say to get better health security for long term, no be only medical treatment go do am, people also need clean water and better sanitation, especially for rural areas. If people get pipe-borne or borehole water near dem, dem no go need waka go those rivers to fetch water. That kind way, dem no go too dey exposed, he explain he assure di people say federal and state governments, plus health partners, dey serious to treat patients and stop di disease from spreading more. Di World Health Organisation sabi Buruli Ulcer as one of di most neglected tropical diseases for di world, wey mostly dey affect rural, river side communities wey no too get access to proper healthcare.
Written by: News Editor 1
ADAMAWA ADAMAWA HEALTH CRISES FLESH - EATING DISEASE
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025