Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Federal Government say dem don take big step to shake life back into Nigeria gas sector and make power supply stable after President Bola Tinubu gree say dem go pay ₦185 billion wey government don owe gas producers .
Minister of State Petroleum Resources (Gas), Ekperikpe Ekpo, yarn dis one on Tuesday say, the move wey National Economic Council (NEC) under VP Kashim Shettima back, na one of di biggest interventions for Nigeria energy sector for recent years.
Di long-standing debt don scatter cash flow, hold back operations, scare investors, and reduce gas wey dey feed power plants, wey dey make light wahala full ground.
Payment go run through royalty-offset system, wey dem believ go ginger confidence among local and foreign gas suppliers.
Written by: News Author
FG gas debt payment Nigeria power sector news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025