By: Esther Ayoola
Former Secretary to di Gornment of DI Federation, Babachir Lawal, don pack im load comot from DI African Democratic Congress (ADC) party.
Lawal use his Facebook page on Monday take announce am on Monday say na Aringas naim package di election for di party presidential primary to favour former Vice President Atiku Abubakar.
Im scata mouth say di election na pure “wash” because dem change di real winners name con put Atiku people, dat dem just write results as e take sweet dem.
Di former SGF sti tuk say e no fit join body with dat kind political structure because e nor  wan get hand for any bad tin wey fit affect future elections.