Sports

Four Must-Win Battles Wey Go Carry Naija Enter World Cup

todayOctober 16, 2025 4

Background
share close

Di Super Eagles of Nigeria still dey chase dia World Cup dream after dem knack Benin Republic 4-0 for Godswill Akpabio Stadium for Uyo. Victor Osimhen score hat-trick and Frank Onyeka add late goal wey make Naija finish second for Group C of di CAF qualifiers. Even though di win sweet, Naija still no qualify straight as South Africa top di group with 18 points after dem beat Rwanda 3-0. Bafana Bafana don carry automatic ticket go di 2026 FIFA World Cup wey go shele for United States, Canada and Mexico. But e never finish for Nigeria, dem still get chance through CAF play-offs.

As one of di best four second-place teams from all nine CAF groups, Super Eagles don qualify for di CAF Play-offs wey go happen for Morocco between November 13 to 16, 2025. For di first phase, Naija go first jam Gabon for semi-final. If dem win, dem go face di winner between Cameroon and DR Congo for final. Win that one again, dem go enter FIFA Intercontinental Play-offs wey go happen for USA, March 2026. There, dem go face teams from other continents like Asia, South America, or CONCACAF. If Naija no dey among di top two seeded teams, dem go play semi-final first. Win that one, then final. Na only if dem win all four matches, dem go land for di 2026 World Cup. Dis tournament go be di first to carry 48 teams, and Africa don get nine slots plus one extra through play-offs, and Naija dey eye am strong.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app