National

Fubara Explain Why Im Move To Di APC

todayDecember 11, 2025 3

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don explain why im cartapot enter di All Progressives Congress, say, im dey carry plenty personal and political wahala because e refuse tell im own side of di tori wey dey cause gbagan for di state.

Di governor yarn dis one as e commission di newly expanded Ahoada–Omoku Road for Rivers West, road wey Julius Berger build and wey be part of im campaign promise.

Fubara talk say, up till now, e never fit still meet with Speaker Martins Amaewhule and other Assembly members because dem only dey attend meeting wey PDP leader, Nyesom Wike, summon and all dis one join why im move.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app