Sports

Guardiola Don Accept Blame For Man City Shock Home Loss To Leverkusen

todayNovember 26, 2025 3

Background
share close

Pep Guardiola don take blame for Manchester City 2-0 Champions League loss to Bayer Leverkusen after e make 10 changes for im starting line-up. Guardiola rotate almost all im players from di Premier League defeat to Newcastle, as only Nico Gonzalez survive from di St James’ Park match. Players like James Trafford, Nathan Ake and Oscar Bobb get rare starts. Before kick-off, Guardiola tell TNT Sports say e for change all eleven players if possible because im squad need “fresh legs” after busy fixtures. But di decision backfire as Alex Grimaldo and Patrik Schick score for Leverkusen, give dem important three points for di race to qualify for di knock-out stages.

After di match, Guardiola admit for TNT Sports say e fit be mistake to tinker with di line-up like that. E talk say: “I understand your question… absolutely, I gats accept am.” E add say even though players dey play every few days, maybe di rotation too much. With di defeat, Man City don lose back-to-back games for di first time since August, and dis na dia second Champions League match wey dem dey drop points dis season. Di loss come ahead of City next big UCL trip to Real Madrid next month.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app