Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di 2025 edition of Hallelujah Challenge, wey be global online praise and worship led by popular Nigerian gospel singer Nathaniel Bassey, don break record again as e pass 1.2 million views across social media during di midnight session on Wednesday. Di News Agency of Nigeria (NAN) report say people from all over di world join for YouTube, Facebook, Instagram and TikTok to worship together on day 15 of di October session. Wetin start as small Instagram Live session in 2017 from Bassey living room don turn to one of di biggest online Christian gatherings for di world. Nathaniel Bassey talk say di kind participation wey dem dey see now na clear sign say na God dey move, not be human planning. “Wetin start as simple midnight praise don turn global altar of worship,” he yan.
Di Challenge dey always start by 11:59 p.m. with one hour of strong praise and prayer. E dey run for set number of days and sometimes end with physical Hallelujah Festival wey dey pack thousands of people for live worship and testimonies. Bassey talk say di movement dey rooted for real worship and collective praise. “This no be just event, na movement. Since 2017, miracles dey happen as people dey gather to praise God,” he talk. Reports from Nigeria and abroad don confirm say viewership dey rise steady for 2025, as testimonies of healing, breakthrough and divine touch dey full everywhere. As October edition still dey go strong, Bassey dey encourage people make dem no slack for praise and faith. “Di world need hope now, and through praise we dey show say God still dey reign and dey answer prayers,” he add.
Written by: News Editor 2
Hallelujah Challenge October session Nathaniel Bassey live session
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025