Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
England captain, Harry Kane, don talk say e no dey too reason Premier League comeback again, as e dey fully enjoy hin life and ball for Bayern Munich. Kane wey just chop Oktoberfest enjoyments over di weekend, don score 18 goals in 10 games dis season, as Bayern start di campaign with 100% performance. Di 32-year-old striker get contract with Bayern till summer of 2027, and e don open mouth say e dey “fully all in” for di German giants, and fit even sign new deal if talks come up. “In terms of staying longer for Bayern, I fit see am happen,” Kane talk. “Dem never talk new contract with me yet, but if dem ready talk, I go sit down reason am.” When Kane comot Tottenham for summer 2023, people believe say e go play small for Germany then return England to chase that all-time Premier League goals record. But now, Kane don cool down that talk. “When I first comot go Bayern, I bin think say I go come back Premier League. But now wey I don dey here for some time, that idea don reduce.
I no go talk say I no go ever come back, but e no dey top of my mind again.” Spurs boss, Thomas Frank, still dey hope say Kane go return England, but Kane wey get £57 million release clause dey see future for Germany instead. Kane don report for England duty ahead of friendlies vs Wales and World Cup qualifiers vs Latvia. Last season, Kane finally win hin first major trophy as Bayern carry Bundesliga, and e say dat success ginger am more: “I wan see wetin I go feel after I win my first title. Instead make I relax, e even push me to do more. I dey eat cleaner, dey hit gym more, reduce cheat meals, less ice cream with family, all na to get better.” According to Bayern sporting director, Christoph Freund, dem believe say na “best version of Kane wey we dey see now.” Kane don even outscore Haaland and Mbappé dis season, and e say di hunger still dey him body to win bigger trophies.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025