By: Esther Ayoola
Say nor small gbege sup for di peace meeting wey George Akume call for All Progressives Congress pipo for Benue state, dat Governor Hyacinth Alia suppose get automatic ticket mata.
But afta di meeting for Makurdi, both sides give different meaning to wetin dem agree, especially about who go get automatic ticket.
Oga, Secretary to di Gornment of di Federation, Akume explain to journalists di peace waka and baba govo, Alia tuk im own too.