Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Director-General of di World Trade Organization (WTO), Ngozi Okonjo-Iweala don tell Federal Government say dem need to fix and upgrade Naija airport dem if dem wan compete for global trade.
She tuk dis one for Aircraft Acquisition and Investment Summit wey happen for Lagos, say beta airport no be choice again but must-do.
She sti advise make gornment join hand with private investors so dat dem fit raise money take modernise aviation sector.
She add say make dem also check high fuel cost, taxes and airport charges wey dey make airline business cost too much, all dis dey importankpa.
Written by: News Author
Airport Investment Nigeria FG Airport Plan Nigeria Aviation Sector Okonjo Iweala Advice WTO DG Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026