Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Former Nigerian international, Mikel Obi, don talk say if no be star striker Victor Osimhen, Super Eagles World Cup hope for 2026 for don die tey tey. Mikel yarn dis one for him Obi One Podcast, as e hail Osimhen for keeping Nigeria’s qualification dream alive. Di former Chelsea man remind Nigerians how Osimhen show class for di final Group C clash against Benin, where di Galatasaray striker score hat-trick for di 4-0 win wey secure Nigeria playoff spot. “If we no win dat match, we for no dey talk about World Cup again. Osimhen singlehandedly keep us alive. Na one of di biggest games, and he step up score three,” Mikel talk.
Mikel still point out say di Eagles dey struggle anytime Osimhen no dey play, noting say dem never win any match wey im miss, instead na four draws and one loss dem get. He talk say di Napoli star dey bring fire, passion and fight wey di team need. “You fit see di hunger and aggression for im body. When pressure don high, na di big boys dey step up, and na wetin Osimhen don do be that. He be di real big man for di team now, and all of us need am,” Mikel add.
Written by: News Editor 1
Mikel Obi Super Eagles World Cup qualifiers Victor Osimhen Super Eagles
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025