By: Esther Ayoola
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don resume nationwide voter registration again and say dis na di second phase of Continuous Voter Registration for di obodo Naija.
Chief Press Secretary to INEC chairman, Na Adedayo Oketola, confirmation dis particular mata give tori pipo on Monday
Dis new phase come afta the first round of CVR wey end officially on December 10, 2025.
INEC dey ginger say Nigerians wey never register or wan update dia details make dem show face now, as di registration process don officially waka again.