By: Esther Ayoola
Say nor be small tin Katsina state, dat some jaguda Bandits, wey carry dangerous weapons enter some communities for di State, kidnap pipo for night.
Witnesses tuk say the armed men attack Unguwar Alhaji Barau before dem move go Gidan Dan Mai-gizo and Gidan Hazo for Na’alma Ward, Malumfashi Local Government Area.
Security pipo never tuk officially, and nobody still know the exact number of people wey die or wey dem kidnap.
Police tuk tuk for Katsina State, Abubakar Sadiq, say e never hear about the attack but promise say e go find out and give update later.