By: Jolayemi Olajide
Say you nor dey know di value of person until u lose am, and dat na di situation of Nigeria as Former Presido, Goodluck Jonathan pay tribute to late Presido, Umaru Musa Yar’Adua marking 16 years remembrance since e kpai.
Jonathan Sukuli dis one for im social media post, dat true, true, Naija dey Miss Yar Adua.
Dat Yar’Adua na true servant leader wey sabi as “Gentleman President” because of him humility and integrity.
Jonathan sti describe am as leader wey always put country interest first before personal ambition.