Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Confederation of African Football (CAF) don confirm say di 2025 CAF Awards go shele for Rabat, Morocco on Tuesday, November 19 by 7 p.m. local time (same as Naija time). According to wetin CAF yarn for dia website on Friday, di big ceremony go celebrate Africa best footballers, coaches, clubs and national teams wey don shine for di past year. Naija go show face well-well for di event as plenty of our players don make di shortlist. Victor Osimhen go dey try defend im African Player of di Year title, while Stanley Nwabali and Daniel Bameyi dey up for Goalkeeper and Young Player of di Year. For women side, Rasheedat Ajibade, Esther Okoronkwo and Chiamaka Nnadozie go represent di Super Falcons inside Women Player and Goalkeeper categories.
Morocco wey dey host di event get di highest number of nominees across many categories, including players from RS Berkane and AS FAR, plus coaches like Walid Regragui and Tarik Sektioui. CAF talk say di award go celebrate “individual and team excellence wey don raise African football name globally.” For di men’s category, big names like Mohamed Salah, Achraf Hakimi, Andre-Frank Zambo Anguissa, and Pape Matar Sarr go battle for di top prize. Di Super Falcons, Morocco Atlas Lionesses, and South Africa Banyana Banyana go dey drag for Women’s Team of di Year. Bayelsa Queens FC go rep Naija for Women’s Club of di Year, while Mamelodi Sundowns, ASEC Mimosas, and RS Berkane dey top di men’s list. Winners go dey announced live for di ceremony wey go gather football legends, administrators, and officials from across Africa.
Written by: News Editor 1
CAF Awards 2025 Morocco CAF Awards
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025