Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Rivers United don enter anoda wahala for dia title chase lossing 4-1 to Nasarawa United for Lafia City Stadium on Monday.
Coach Finidi George bin tuk say dem go like return back to di top of di table after Rangers win 2-0 on Sunday, but Nasarawa quick goals spoil dia plan.
Ngei Oluka-Efor and Abubakar Abdullahi quick quick score two goals for Nasarawa, while Chimezie Victor add another, before Taiwo Abdulrafiu score small consolation for Rivers.
JoFrank Istifanus seal di 4-1 win two minutes before sixty minutes, show say Nasarawa strong pass Rivers United for away match.
Written by: Ridwan Agbomeji
Lafia Stadium match Nasarawa United vs Rivers United Nasarawa United win NPFL match result
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026