Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Edo State Governor, Monday Okpebholo, don sign new law wey go carry 10 years jail for anybody we force or violently enter government property for di state. Di governor still sign another section wey talk say anybody we sell or transfer government land without di governor consent go face five years imprisonment. Dis one follow statement from di governor Chief Press Secretary, Fred Itua, wey drop on Tuesday for Benin. Itua talk say di new Edo State Public Property Protection Law 2025 show say Okpebholo government no dey smile with corruption, impunity and misuse of public assets. Di law create one committee wey go protect, recover and safeguard all government properties for Edo.
According to di statement, di committee get power to stop unauthorized occupation, vandalism, or encroachment of government land. Dem fit seal and recover any property wey person don take over, investigate land wahala, and work with police to enforce di law. Dem also get right to carry people go court through di Ministry of Justice. Okpebholo talk say public property belong to di people of Edo, no be for private pocket. Under di new law, if you sell or transfer government land without approval, na five years jail, but if you force enter or destroy government property, you fit bag up to 10 years depending on di offence. Professionals wey help for illegal land deals go face sanction and even get reported to dia professional bodies. Di statement warn say fake petition or fraudulent claim over government land go carry serious penalty.
Written by: News Editor 1
Edo government property law Okpebholo Edo news
todayNovember 5, 2025 12 3
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025