Sports

NFF Promise To Pay Super Eagles Coachie Im Three Month Gbese Ahead Of AFCON 2025

todayDecember 10, 2025 7

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Unto matter for sport, Nigeria Football Federation don comout clear fans doubt say dem go pay di Super Eagles coachie, Eric Chelle, salary wey dem owe am before di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco.

NFF top official talk say, dem dey owe di franco Malian Coachie Chelle three months salary plus bonuses, and dem wan pay am make e fit prepare di team wella.

Di NFF official say Nigeria, along with 23 other teams, suppose arrange 28 players for di AFCON, with Chelle expected to announce im final  squad between December 10 and 11.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app