Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
National Vice Chairmo of New Nigerian Pipo Party for Northwest, Sani Danmasani, don reveal tuk say oga Govo of Kano state, Abba Yusuf, na be di real leader of di party, no be Rabiu Kwankwaso.
Im sukili dis one for inside statement, say according to NNPP constitution, anybody wey be sitting governor and party member automatically be leader, and na why Abba Yusuf take get dat position for Kano and nationwide.
Dis one sef dey come, supporters for Kano state dey drag marra on wo be di real leader of di party for kano state
Danmasani explain oh, dat Kwankwaso only be NNPP presidential candidate for 2023 election because of agreement between NNPP and Kwankwasiyya Movement, and dat agreement end immediately after di election.
Written by: News Author
Nigerian politics news NNPP leadership NNPP party chairman
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025