National

Northern Govs Wan Lock Mining For 6 Months, Scatter Ground With ₦228bn Security Cash

todayDecember 2, 2025 8

Background
share close

Govos and Traditional Rulers for north don form geng enter meeting for Kaduna, order say make mining stop for at least six months, and dat illegal mining, na im dey cause all di katakata of security for di North.

Di leaders dey para say dat pipo dey face serious gbege wit Jaguda boys and so don set up regional Security Trust Fund, wey every state and local gornment go drop ₦1bn monthly to rascal di Jaguda boys for North.

For di announcement wey dem drop after di Kaduna meeting on Monday, di govos yarn yarn marras dat Security Trust Fund go bring beta owo for ground to run joint patrols, intelligence waka, and handle security wahala across di North.

Dem dey feel for Kebbi, Kwara, Kogi, Niger, Sokoto, Jigawa, Kano, Borno and Yobe pipo wey dey face security palava, salute soldiers, and give oga Presido Bola Ahmad Tinubu thumbs up as demma take try release those school childrenses from those Jaguda boys. Di Forum dey beg Presido make e run enter di bad boys’ hideouts sharp-sharp, make peace land for North and make people fit finally dey free.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app