Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Aussie coach chop sack just few minutes afta Chelsea knack Forest 3–0 on Saturday afternoon. Di club no waste time as dem sharply bring in Dyche to try rescue di season wey don dey scatter. Postecoglou own short and bitter 39-day stay no produce single win inside eight matches for all competitions. Na serious wahala as di poor results drag Forest go relegation zone and make dia fans vex well-well. Dem no smile at all as di team dey fall yakata under di former Spurs boss. Forest board no waste time at all to find new manager as dem hand former Everton and Burnley boss, Sean Dyche, contract wey go run till 2027. Dyche don dey without job since Everton sack am for January, but now di Tricky Trees don carry am come back sideline. Dem bin reason other options like Fulham boss Marco Silva and ex-Man City and Italy manager Roberto Mancini, but finally choose Dyche. Na Silva £8 million release clause com price am out of di race. For official club statement, Forest yarn say: “Nottingham Forest dey happy to confirm say Sean Dyche na di Club new Head Coach, afta serious recruitment process wey Global Head of Football, Edu Gaspar, and Global Technical Director, George Syrianos lead.
Di former Forest youth player don sign contract wey go last till summer of 2027 and im first match go happen Thursday night as Di Reds go jam FC Porto for Europa League.” Di club hail Dyche say him na Premier League manager wey get respect and experience, wey sabi set team wey dey solid, strong for set-piece and full of resilience. Dem talk say as Dyche don manage over 330 Premier League games and still be former Forest boy wey dey live for area, e go fit carry di club enter next level with im tactical brain and man-management skill. Dem believe say e fit give dem better season both for home and for Europe. For Sean Dyche, dis job no be just another coaching gig, na real homecoming. Di manager start him football journey for Forest youth academy back for late 1980s, under legendary Brian Clough, even though he no make senior appearance before he move on. For one old interview with Sky Sports, Dyche talk say: “Plenty of us dey that time. We go run around Nottingham, drink small beer after match, like normal. Na good times, no doubt. Very important years for me. Everybody sabi how di team dey play, and wetin dem expect. E dey inside di club DNA. If you fit build am, na big asset. But these days, people wan change everything, so to build club from scratch no easy at all.” Dyche still dey remember di days wey him dey train with Tony Loughlan and Gary Charles, two ex-teammates wey him still dey keep touch with. “We still dey laugh about old times and life back then,” he add. Dyche go no dey waka alone for Forest, as him two trusted men, Ian Woan and Steve Stone, go follow am enter di tactical room. Di two na real legends for City Ground with over 400 appearances combined for Forest during di 1990s, dem sabi di club well, and dem go bring plenty experience join Dyche mission.
Written by: News Editor 1
Nottingham Forest new manager Sean Dyche appointment
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025