Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Nigeria Premier Football League (NPFL) don warn say any club wey im ball boys dey waste time during match go pay fine of ₦1 million. NPFL Chief Operating Officer, Davidson Owumi, drop dis tori for one circular wey dem send give clubs, say make dem reorient dia ball boys make dem dey promote fair play and respect di game. According to di statement, “Any team wey dey encourage or do dat kain thing go collect ₦1 million fine, as e dey against fair play and e dey spoil di image of di game.”
Owumi still yan say dat kain act na big misconduct under NPFL rules, and di league no go gree make anybody rubbish di integrity of football. He talk say dem dey serious about discipline, fairness, and professionalism for all match wey dem dey play. Di NPFL don use dis one warn clubs say dem no go look face if anybody try play rough game or use delay tactics to win.
Written by: News Editor 2
NPFL ₦1 million fine NPFL latest news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025