By: Esther Ayoola
Former Presido, Olusegun Obasanjo don praise one new campaign wey dey fight cancer through awareness and early detection.
Baba Obasanjo yarn dis one on Sunday for inside im Presidential Library for Abeokuta, during one event wey ‘Lagos to the World Initiative’ organise.
Di event na for remembrance of di founders wey be mama and sister wey cancer show shege.
Obasanjo tell di family say wetin dem do make sense, as dem turn dia personal loss to something wey go save plenty regular pipo life.