National

Oga Presido Tinubu Send Letter Of $6B Foreign Loan To Senate

todayMarch 31, 2026 3

Background
share close

Wi oga Presido Bola Tinubu, don enter senate again dey ask dem to approve $6 billion loan from outside to help run gornment.

Na for two separate letters request  him send to Senate President Godswill Akpabio and naim im put dis one and dem read during Tuesday’s plenary.

For one letter, e dey seek $5 billion from Abu Dhabi Bank to hellep finance budget.

For another letter, e ask for $1 billion from Citibank for fix key port work like Lagos Port Complex and Tin Can Island Port.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app