Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Former Super Eagles star, Sunday Oliseh don hail midfielder Alex Iwobi after e make history as di first Naija player wey don play 300 Premier League matches. Iwobi reach dis big milestone during Fulham weekend match against Newcastle United for St. James’ Park. Di 29-year-old start im Premier League journey for October 2015 when e debut for Arsenal against Swansea City, and since den, e don play for three clubs , Arsenal (100 matches), Everton (123), and now Fulham (77).
Oliseh celebrate am for him official X handle, as e write: “Congrats Alex! for me one, e dey sweet to see dis player dey improve. Real talent!” Iwobi still remain key man for both Fulham and Super Eagles, and dis achievement don stand as one big win for African football and Naija pride.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025