Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Victor Osimhen shine yesterday for Godswill Akpabio Stadium, Uyo, as Nigeria hammer Benin Republic 4-0 to qualify for African playoff for 2026 World Cup. Nigeria need win Benin and hope Rwanda go beat South Africa for di last Group C games. Nigeria win their game but South Africa still hammer Rwanda 3-0 to grab di group winner ticket go North America. Dis win put Super Eagles for African playoffs, where dem go play one of Gabon, Cameroon or Burkina Faso next month for Morocco.
Di game no reach three minutes when Osimhen catch one pass from Samuel Chukwueze to open scoring for Nigeria. Osimhen add second goal for 37th minute after sharp team play wey expose Benin defence, make fans for Uyo stadium scatter ground with joy. Osimhen no stop as e head in Moses Simon free-kick before half time to make am 3-0. For second half, substitute Frank Onyeka lock Nigeria spot for playoff with fine volley from Simon cross. Only group winners qualify direct for World Cup, while runners-up like Nigeria go playoffs. Nigeria rank third among group runners-up behind Cameroon and Gabon, with Burkina Faso join di list. Dis four teams go play semifinal, winners go face each other for final to decide Africa ticket for inter-confederation playoffs in March next year.
Written by: News Editor 2
2026 World Cup Qualifiers Africa Victor Osimhen Super Eagles
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025