Sports

Osimhen Nor Too Happy With Galatasaray Win Over Juventus

todayFebruary 26, 2026 4

Background
share close

Super Eagles striker Victor Osimhen talk say e no sweet am di way Galatasaray play, even though dem still knock Juventus comot for UEFA Champions League play-off on Wednesday.

Galatasaray manage crawl enter Round of 16 with 7-5 aggregate win afta extra-time battle for Turin, despite say Juventus nearly turn di tie upside down.

Osimhen drag one goal back when Juve bin don lead 3-0, push di aggregate to 6-5, before Baris Alper Yilmaz seal am late to scatter Juve comeback plan.

For one interview, Osimhen hail Juventus effort but clear mouth say if dem wan survive next round against big boys, Galatasaray must raise dia game sharp sharp.

 

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app