Sports

Palmer Go Sidon For Three Weeks To Manage Groin Injury

todaySeptember 26, 2025 4

Background
share close

Chelsea player Cole Palmer go rest for about three weeks as e still dey manage one groin injury wey no dey go. Palmer comot for pitch for first half of last weekend game wey Chelsea lose for Manchester United after di injury show again, because e first start during di short two week pre season after Chelsea win Club World Cup for July. Enzo Maresca side go face Brighton and Liverpool for Premier League, plus Jose Mourinho Benfica for Champions League before October international break. ‘Yes, we decide to protect Cole, make hin injury no worsen,’ Maresca talk.” We gree say make we rest am for like two to three weeks reach di international break, make we see whether with that rest, him fit recover 100% and come back fit after di break.

I no believe say e need surgery, na just to manage di pain wey dey im groin. We don decide say make we play am safe small with am. Palmer don start only three out of Chelsea seven matches so far dis season, and e miss England World Cup qualifiers against Andorra and Serbia earlier dis month. Di Three Lions go play friendly with Wales on 9 October before dem travel go Latvia for World Cup qualifier five days later. Maresca go still miss Tosin Adarabioyo till after di international break because of calf injury. Defender Wesley Fofana no go play Saturday match against Brighton because of concussion.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app