National

PDP Drag FG As US First Break News Of Sokoto Terror Strikes

todayDecember 26, 2025 8

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Di Peoples Democratic Party don bash Federal Govment for how e allow United States release news of terror strikes for Nigeria before Nigerian authorities yarn anything.

In a statement issued on Friday, di PDP National Publicity Secretary, Ini Ememobong, PDP talk say di govment delay make Nigerians dey depend on foreign sources for updates about critical security operations for dia own country.

Di US first announce dia military strikes for Sokoto State for social media, hours before Nigeria Ministry of Foreign Affairs confirm di operation.

PDP yarn say Federal Government suppose lead di announcement to properly inform Nigerians, no be make dem dey follow news wey don dey public already.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app