Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Di 2023 Presidential candidate of Labour Party, Oga Peter Obi again don advice wi Federal Government say make pause di new tax laws wey dem just gazette, say plenty error and policy wahala full inside am.
For statement wey e post for X on Tuesday, Obi tuk say tax expert wey dem call KPMG Nigeria report show problem plenty wahala for di tax reform, say dividend, non-resident company mata and foreign exchange deduction, all get problem.
E say di review find about 31 serious issues, including bad drafting, policy confusion and weak administration, wey even professionals need private meeting before dem fit understand am.
Obi warn say if experts dey struggle to understand di law, ordinary Nigerians go suffer, say, tax system suppose base on trust and proper consultation with di people.
Written by: News Author
Economic Policy Nigeria New Tax Law Nigeria Opposition Reaction Nigeria Tax Reform Debate
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025