Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Police arrest suspected militant for sea piracy, declare monarch wanted for Akwa Ibom. Operatives of di Akwa Ibom State Police Command, join hand with marine hunters, don arrest one suspected militant, Samuel Geoffrey, wey dey allegedly specialize for sea piracy and k!dnapping for Ibaka, Mbo Local Government Area. State Commissioner of Police, CP Baba Azare, yarn journalists for Uyo on Tuesday, November 4, 2025, say di command don start manhunt for one traditional ruler wey dey believed to dey collaborate with Geoffrey and reportedly get some operational tools wey di militant dey use. CP Azare talk say di suspect dem arrest on November 3, 2025, around 11:45 am, while di traditional ruler run comot wen police storm im residence.
CP Azare add say wen dem search di monarch makeshift residence, dem recover plenty items wey dem suspect say dem dey use for sea piracy, including one 40HP, two 15HP, and one 8HP marine engines; four power heads; four gearboxes; four propellers; four engine covers; one Snow Sea deep freezer; and three generators, among others. Azare yan say di 27-year-old Samuel Geoffrey, wey from Atakpere Community, Ekeremo LGA of Bayelsa State, don confess say e dey involved in sea piracy and k!dnapping. Im rifle dey with Kingdom Bane, Village Head of Ine Eyoabasi Fishing Village, wey run when operatives storm im village. Among di items wey dem recover still include three brand-new toilet seats, two brand-new toilet sinks, one sewing machine, and personal effects of one Chibuike Vincent Awah from Onitsha, Anambra State, including im ID card and NIN slip.
Written by: News Editor 1
Akwa Ibom news today Kidnapping suspect arrested Sea piracy Nigeria
todayNovember 5, 2025 13 3
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025