By: Alice Iduh
Nor be small gbege for imo state , say gunmen go burst Amala Community, Ngor Okpala, Imo State, open fire for one Toyota Highlander and kpai di driver on di spot.
Dem later drag di passenger from one Lexus commot, and up till now the poice never sti fit confirm how many pipo dem carry.
Police PRO, Henry Okoye, yarn say di wounded driver wey dem rush go hospital later kpai, and confirm say Commissioner Aboki Danjuma don order serious manhunt with other security people and vigilante to track deir trail