National

President Tinubu Salute Naija Army For Protecting Democracy

todayDecember 8, 2025 4

Background
share close

By: Alice Iduh

Wi Oga Presido Bola Tinubu,  based on doings don cut cap  for  Nigeria armed forces for di way dem rush  help Republic of Benin stop coup wey scarra the country Sunday.

According to di President, wey him talk through him Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, di military restore democracy after di coup plotters capture National TV and one military camp.

Tinubu yan say di forces act according to ECOWAS rules and make Nigeria proud as dem protect democracy.

 

E add say Nigeria go continue dey support Benin government and people, as di Air Force jets enter Benin airspace to dislodge di plotters.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app