Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Tinubu don nominate former Senator, Magnus Abe as chairmo of di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC), plus 20 other pipo for boards of key oil agencies.
Special Adviser to di Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk for statement on Monday say Abe go lead NUPRC board together with other non-executive commissioners like Paul Jezhi and Sunday Babalola.
Tinubu also nominate seven executive commissioners, including Muhammed Lamido for finance and Olayemi Adeboyejo as secretary and legal adviser, to make sure di board fit run oil industry well.
Oga Presido dey seek quick Senate approval for dis people so dat dem fit manage and oversee Nigeria’s petroleum sector better.
Written by: News Author
Magnus Abe appointment Nigeria oil and gas regulator NUPRC chairman
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025