Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Five big European clubs don enter serious battle to sign Victor Osimhen from Galatasaray as summer transfer window dey approach.
Bayern Munich dey plan to bring Osimhen replace Harry Kane, as coach Vincent Kompany wey don watch am since im Belgium days don give green light for di move.
Paris Saint-Germain also dey chase Osimhen because dem want strong striker for their attack, while Manchester United, Juventus and Atletico Madrid still dey monitor im form and contract matter.
Di 27-year-old Super Eagles striker still dey shine for Turkey, and clubs dey watch am closely as transfer battle dey hot up.
Written by: Ridwan Agbomeji
Osimhen news Osimhen PSG Bayern transfer Victor Osimhen transfer
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026