Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Nigeria table tennis star, Quadri Aruna, never fit win any WTT match 2026, again don go lose 3–0 to France player Félix Lebrun for WTT Champions Chongqing on Tuesday.
Lebrun, wey dey 19 years old, hammer Aruna 11–5, 11–6, 11–3 for round of 32.
Dis one make Aruna still dey wait for im first WTT win since September 2025, wen e beat China player Huang Youzheng.
Na dia fourth time wey dem meet, and Aruna don win only once before.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026