Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Unto UEFA champions league update say Real Madrid go face Benfica, while PSG don jam Monaco for Champions League knockout play-off afta draw for Nyon on Friday.
Di draw bring plenty big matches and like dis teams dey fight to enter round of 16 under di new Champions League format.
Borussia Dortmund go battle Atalanta, Galatasaray go jam Juventus, while Atlético Madrid go face Club Brugge, Olympiacos go meet Bayer Leverkusen again.
And Qarabağ also get serious test as dem go play Newcastle United for di first time ever.
Written by: News Author
PSG vs Monaco Real Madrid vs Benfica UCL Playoffs UEFA Champions League 2026
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025