By: Esther Ayoola
Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, Once again dey beg Nigerians to join bodi together build di country call Naija, say na only unity go hellep move di country forward.
Mama Tinubu yarn dis one on Thursday for Leadership Annual Conference and Award 2025 wey happen for Abuja.
Senator Oluremi say, e dey importakpa for pipo to forget religion and region scata scata, and dat na only when everybody work as one, Naija fit overcome both local and global wahala.