National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

todayDecember 9, 2025 6

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

For abuja,  afta all di plenty drama for Osun state between di dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birthday message give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60.

Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, Mama Remi  dey hail Madam Adeleke for di serious work wey she dey do to uplift Osun people through di renewed hope initiative.

She talk say di Osun first lady dedication don turn many lives around and her impact dey show everywhere for di state.

To crown di ogbonge greeetings, Oluremi  throway  better salute wey get odour  give Governor Ademola Adeleke, di celebrant childrensis and entire family.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app