Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Superstar footballer, Cristiano Ronaldo, don open mouth again for di long-time argument wey football fans don dey drag, who be di greatest footballer of all time between am and Lionel Messi. Di Al Nassr and Portugal captain yarn dis one for new interview with British broadcaster Piers Morgan, where e talk say Messi no better pass am. For di interview preview, Morgan ask am, “Dem dey talk say Messi better than you, wetin you think?” Ronaldo reply with confidence, “Messi better than me? I no gree with that opinion. I no wan form humble.”
When dem still ask am about Wayne Rooney, im former Manchester United teammate wey don talk before say e prefer Messi, Ronaldo just respond calm, “E no dey bother me at all.” For years, football fans and analysts don dey argue who senior who between Ronaldo and Messi, as di two don win plenty titles for club and country. But na Ronaldo get five Ballon d’Or, while Messi don collect am eight times, making di GOAT debate still hot for street.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025