By: Esther Ayoola
Unto ogbonge update from banking sector say Chairmo and founder, of Africa biggest bank, Jim Ovia, don retire as e tenure don end.
Di announcement come out on Tuesday for dia 35th Annual General Meeting wey sti dey go on, dem confirm am for statement too.
Di bank tuk say Ovia comot afta e complete di mandatory 12 years as non-executive director and chairmo, as Central Bank of Nigeria governance rules require.
Ovia become chairman for July 16, 2014, afta e serve as founder and Group Managing Director/CEO from 1990 to 2010.