By: Jolayemi Olajide
Di Former Vice President Atiku Abubakar on Friday give President Bola Tinubu seven days notice make he sign di Federal Audit Service Bill into law or pack his load comot from office.
Atiku throw dis stones inside one statement wey his Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release for Abuja because Tinubu never act on di bill months after National Assembly send am give am.
Di former VP talk say dis delay dey show say Tinubu dey use executive power play anyhow.
To make sure say transparency dey, Atiku drop warning say if Tinubu refuse to give reason why he dey hold di bill back, Nigerians no go get choice than to demand make he step down for office.