National

Somtochukwu Jump From 3rd Floor: FCT Police Oga Talk

todayOctober 2, 2025 6

Background
share close

The Federal Capital Territory (FCT) Police Commissioner, CP Ajao Adewale, don confirm say Arise News anchor, Somtochukwu Maduagwu, die after she jump from di top floor of her Katampe apartment during armed robbery on Monday. Vanguard report say Vigilantes for the compound tell neighbours say after Somtochukwu jump from the top floor of di 3-storey building, she land for di hard cement floor, lose consciousness, and dem find her for bad condition before dem rush her go hospital. CP Adewale talk say “Police men come the scene, see her dey lie down unconscious.

Dem carry am quick go Maitama General Hospital, where doctors try CPR to bring am back, but sadly, she no fit make am.” He talk say di robbers enter Unique Apartment, one three-story twin building wey get 18 flats, wey dey around Gishiri area for Katampe, under Mabushi Divisional Area. “Some unknown armed robbers enter Unique Apartments wey Maduagwu dey live. “Two private security guards dey on duty. One of dem wey get courage to fight di robbers, carry gunshot injury. “For di kain panic wey follow, Maduagwu wey live for di top floor of di building jump down from di third storey.” “Di consequences na tragic and very unfortunate,” Adewale talk. Investigation team wey Deputy Commissioner of Police (Investigation) dey lead don set up to track down di attackers. E assure say, “No stone go dey untouched until dem bring di people wey do am come face justice.” “We don set up one special investigation team wey Deputy Commissioner of Police, Investigation, dey lead, and all tactical units dey involved to track down di culprits.” “Di leads wey we dey get, we don dey work on dem already, and no stone go dey untouched until dem catch di people wey do am bring dem go justice. “FCT Command once again dey commiserate with Sommie family, Arise News family, and all Nigerians wey pain reach for dis bad and disturbing matter,” e talk.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app