Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Sports
todayDecember 11, 2025 8
By: Rilwan Agbomeji
Former Naija winger, Tijani Babangida don tier better warning, role am, package am, give wi Super Eagles coach Eric Chelle say, make e no base di team only on striker Victor Osimhen for di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco.
Na for tuk tuk session with tori pipo on Wednesday, Babangida dey talk dis one, say e dey risky as Naija dey depend too much on Osimhen, especially afta dem struggle wen Osimhen comot for second half against Dr Congo for 2026 World Cup play-off.
E yarn mata, say Super Eagles wey im dey play for no dey rely on one player, and Chelle suppose fix di matter before di tournament.
Written by: News Editor 1
AFCON 2025 Nigeria NIGERIA FOOTBALL NEWS Super Eagles legend Babangida Super Eagles squad update
todayDecember 12, 2025 11
todayDecember 12, 2025 3