Nigeria Super Eagles don waka go up three steps for di new FIFA ranking, even though dem no qualify for di 2026 FIFA World Cup. Eric Chelle men wey dey 41st for October don enta 38th position now. Nigeria still dey number five for Africa behind Morocco, Senegal, Egypt and Algeria. For di period wey FIFA review, di Super Eagles play two matches dem hammer Panthers of Gabon 4-1 for semi-final of di playoffs, but later lose 4-3 on penalties to Leopards of DR Congo for di final.
For di global table, Spain still dey sit down gidigba for number one ahead of Argentina, France and England. Brazil climb two spots go fifth, waka pass Netherlands and Portugal. Portugal fall go sixth, Netherlands drop enter seventh, Belgium hold dia eighth position, while Germany and Croatia complete di top ten.