Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Say Five pipo don Kpai for Entekpa community, Adoka, Otukpo LGA, Benue State afta suspected armed herdsmen attack.
According to report, di Gunmen still ambush one commercial bus for Utonkon, kpai two passengers, and kidnap 14 people.
Some villagers for Adoka suffer gunshot wounds, while plenty others don miss.
Eyewitness say, di attackers come with plenty cows, then suddenly start to shoot pipo and burn house.
Ward Head of Entekpa, Oliver Inalegwu, con sti konfamamte di report, say na herdsmen attack di village.
E say, like dis, di village don empty, blood everywhere.
Written by: News Author
Benue community abduction Benue kidnapping news Suspected herdsmen attack
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026