UK Don Order Poultry Restriction As Bird Flu Dey Spread
Di UK goment don order make all poultry and captive birds for England remain indoors from Thursday, November 6, as bird flu don begin waka up and down for di country. For di statement wey dem drop on Tuesday, November 4, di Department for Environment, Food and Rural Affairs (DEFRA) talk say di new rule go affect anybody wey get more than 50 birds or dey sell or give egg […]