Police Explain how Kidnappers kramp JAMB Candidates For Benue
Police for Benue don konfam say gunmen kidnap 14 passengers wey bin dey travel from Makurdi go Otukpo, and dat, most of dem na JAMB candidates. Di Commissioner of Police, Ifeanyi Emenari, clear tori pipo say di mata hapun on Wednesday night when dem dey inside Benue Links bus. Emenari add say police don mobilise DPOs and other officers for Otukpo area to try rescue di victims. E also konfam […]