Obodo Niger

32 Results / Page 1 of 4

Background

Obodo Niger

NDC, ADC and Others Drag Tinubu Gorment For Independence

By: Mariam Ajayi Nor be small toks we use our ears hear yesterday wey be naija independence  day. While baba presido dey calim say nigeria don move from reform top prosperity kountry. Opposition including nigeria democratic part presidential candidate, Peter obi and Africa democratic Congress, Atiku Abubakar  press yans nor be small surffali nigerians under under di Tinubu gorment, dat 2027 na anothe ropportunate to correct every every.

todayOctober 2, 2026 8

Obodo Niger

Tinubu Order 95% NIN Registration By December 2026

By: Ayobami Dada Presido Bola Tinubu don order make Naija reach 95 per cent NIN enrolment coverage by December 2026, as hin tok am on the 8th National Identity Day celebration for Abuja on Wednesday. Tinubu, wey hin Chief of Staff Femi Gbajabiamila represent, say Federal Government dey build digital infrastructure wey go help use Naija identity system drive economic growth. Hin say gofment wan make secure national ID useful […]

todaySeptember 17, 2026 11

Obodo Niger

Former First Lady Aisha Buhari Visit Atiku

By: Ayobami Dada Former First Lady Aisha Buhari don visit former Vice-President Atiku Abubakar. Atiku reveal di visit for one post wey e make for X on Wednesday, as e describe di meeting with di former First Lady as “warm and deeply appreciated.” Di former Vice-President say di visit also show di need for everybody wey dey seek better Nigeria to put di welfare and future of Nigerians first. Atiku […]

todaySeptember 17, 2026 9

Obodo Niger

Ondo Gofnor give kidnappers, criminals 14 days to comot from forest

By: Ayobami Dada Ondo State Gofnor, Lucky Aiyedatiwa, don give kidnappers and other criminals wey dey hide for di state forest 14 days to comot. Di Gofnor Senior Special Assistant on Forestry, Bidemi Obayangban, make dis one known during interview with newsmen on Wednesday for Akure. Obayangban say di order dey mainly target kidnappers and other criminals wey dey use di forest as hideout. And e add say di move […]

todaySeptember 17, 2026 9

National

INEC Shift Deadline for Presidential, NASS Candidate List

By Ebi Oboko Independent National Electoral Commission (INEC) don extend di deadline for political parties to submit names and credentials of candidates wey go contest 2027 presidential and National Assembly elections. Di electoral body say parties now get until midnight on Tuesday, July 14, instead of di earlier Saturday, July 11 deadline. According to INEC, di extension follow appeals from some political parties wey complain say dem face challenges to […]

todayJuly 12, 2026 24 16

National

NDLEA Gbab South African Woman With Heroin for Abuja Airport

Edited by Ebi Oboko Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don gbab one 38-year-old South African woman, Will Ann, for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja,say she carry 5.75 kilogrammes of heroin enter Nigeria. NDLEA spokesman, Femi Babafemi, tok say operatives arrest di suspect during inward clearance of Qatar Airways Flight QR1433 from Doha after dem discover 14 big wraps of heroin wey she allegedly hide inside two suitcases. Babafemi […]

todayJuly 12, 2026 24 14

Local

Anambra Ban School Graduation, Christmas Party Again

Edited by Ebi Oboko Anambra State Universal Basic Education Board (ASUBEB) don remind all public primary and junior secondary schools for the state say graduation ceremonies, Christmas parties and graduation levies still dey banned. For circular wey Executive Chairman Dr. Justina Anyadiegwu sign on July 10, 2026, ASUBEB say the directive na part of Anambra State Gornment policy for basic education schools. Di  board order Local Government Education Area officers […]

todayJuly 12, 2026 26 16

National

President Tinubu Give Kudos to Security Agencies Over Oyo School Pikins Rescue

Edited by Ebi Oboko Wi oga Presido, Bola Tinubu don express joy as security agencies rescue di school pikin dem and teachers wey kidnappers hold for 56 days for Oriire community, Oyo State. Baba Seyi  hail di military, DSS and Nigeria Police for di successful operation wey lead to di arrest of eight suspected kidnappers while security operatives neutralise oda gang members. Tinubu also sympathise with di victims and dia […]

todayJuly 11, 2026 27 3

Obodo Niger

US Supreme Court knock Trump, rule say birthright citizenship must stay

By : Jolayemi Olajide Omo blow, blow don burst, dat  United States Supreme Court don block Presido, Donald Trump order wey bin wan end birthright citizenship for US soil. This judgment na big slap for Trump face as e dey try change  immigration law for  America. U sabi say, When Trump enter office on January 20, 2025, E sign one executive order, say if any parent go born for America […]

todayJune 30, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds