Gunmen Shoot Butcher Dead Inside Lagos Barracks Market
Serious gbege burst early Saturday morning as unknown gunmen storm Mammy Market inside military barracks for Ojo LGA, Lagos, come shoot one butcher wey dem call Ridwan. Di attack happen around 8am as traders just dey open shop. About four gunmen wey wear mask enter di market, fire shot into air scatter everywhere, come go straight to Ridwan meat stall shoot am multiple times. According to eyewitness dem, di gunmen […]